Ms Giuffre post for Instagram say she suffer kidney failure after her car collide with one school bus, she say her doctors don give her "four days to live" and dem dey transfer her to a specialist hospital. Inside statement she share with BBC, her spokesperson Dini von Mueffling say: "Virginia dey for serious accident and dey receive medical care for hospital. She greatly appreciate di support and well wishes pipo dey send." For 2001, at di age of 17, she say Epstein bring her to London and introduce her to Prince Andrew. One now famous photograph wey she say dem take on dat night show di prince wit im arm around Ms Giuffre, as Maxwell dey smile for di background. For her civil case, Ms Giuffre allege say di prince sexually abuse her three times - for Maxwell London home dat night, and later for Epstein homes for Manhattan and Little St James for di Virgin Islands. She say she convince di wealthy financier to pay for her to get training to become a real professional masseuse and e arrange for her to take di class for Thailand. But she bin also dey expected to bring home one Thai girl wey Epstein bin arrange to come US.
CONTINUE READING